1. If who no go school won call corona virus, na corona makus or corena festus he go call am.

2. Monkey wen won see Hunter face go collect bullet.

3. Bitter leaf dey sweet goat no mean say he no go shop the meat make you they dry for fire.

4. Goat na fool, goat na fool, no mean sey he go run for fowl.

5. E go better, e go better, na em poverty take dey start.

6. Mr. Ibu is a fool, Mr. Ibu is a fool, na em he take make life.

7. I want to help you, na oyibo man take dey deceive black man till today.

8. Na person wey never see problem dey use English dey pray.

9. Book wey no gree enter head go enter exam hall.

10. Goat wey get mind follow lion go catch fish, make e know say weda dem catch fish or not, Lion food don set oh.

11. Hand join hand na work take dey move oh.

12. If God stand on top cocoayam leaf, e go brake Cutlass.

13. If na by seniority, Methuselah for rich pass Solomon.

14. Woman wen Mary Kay carry enter husband house, na many things dey pursue am comot.

15. "He is not my type" na em Nkozi take enter menopause.

16. Who naked no dey chuck hand for pocket...!

17. Wetin concern dog with family planning?..

18. Na determination dey make Okada overtake trailer for road.

19. Person wen dey cry dey still see road oh.

20. Cockroach wen drink cash enter fowl front, na for inside fowl belle him eye dey clear.

21. Only one more shot na em drunkard take dey start carreer.

22. My name na Success no dey stop poverty.

23. If you use "Warri no dey carry last" take go play lotto, you go know say na joke we dey oh.

24. This one good, this one good na em mad man take dey gather plenty load.

25. Pikin wey go strong go strong.... No be say until dem name am Samson.

26. Na over confidence make February no complete.

27. Do you know who I am? Do you know who I am?..Naso hold up take dey start.

28. Head wey no wan think, go carry load

29. I believe I can fly na em small pikin take dey chop witch oh.

30. Hand wey stay long for pocket, know say nothing dey that pocket.

31. Forget Trust If trust dey, Water no for boil Fish.

32. No matter how lizard do press-up reach, e no fit get muscle pass crocodile.

33. E de clear pimple, e de clear pimple na so bleaching take start.

34. If to say life easy for coven, witch for no dey confess.

35. Work no dey na em lazy man take dey chop free food.

This proverbs sweet, this proverbs sweet no mean say you no go share am give others make them for join follow you laugh oh..

Post a Comment

Previous Post Next Post